Shoprite exit Nigeria: Di retail company don put dia supermarket for di West Africa kontri on sale – See why

Shoprite Nigeria

BBC
Shoprite don dey Nigeria for 25 years

Shoprite retail company, wey be Africa number one supermarket chain, on Monday announce say dem dey consider to end dia business for Nigeria.

Di South Africa company, wey open dia first store for Lagos in 2005, say dem dey find buyer for dia business inside di West African kontri.

Dis go come as shock and surprise to many Nigerian shoppers and customers wey see Shoprite as one of di biggest supermarket for di kontri, especially as sign no show say dem dey struggle.

Inside di half-year company report wey dem release on 3 August, Shoprite say investors don dey offer to buy dia business so tey di board don reason am to sell.

“Di board don decide to formally consider to sell all, or majority shares on Retail Supermarkets Nigeria Limited, wey be subsidiary of Shoprite International Limited,” di report bin show.

Wit 25 shops across Nigeria, Shoprite dey employ at least 200 pipo.

One public relations consultant to Shoprite for Nigeria, Mr. Ini Achibong tell di BBC say e don tey wey di company don dey find investors wey go buy and say nothing don change for di Nigeria operation for now.